TINUBU DON GO BORROW AGAIN!
President Bola Ahmed Tinubu don go meet National Assembly again o, e dey beg make dem approve fresh loan.E no be small loan o - na $20.5 BILLION DOLLAR plus €1.04 BILLION EURO e wan borrow from outside country.
As Senate dey do plenary on Tuesday, na Senate President Godswill Akpabio read the letter where Tinubu talk say e need the money to do big big projects like road, light, school, hospital and other things for inside country.But the matter be say, 2027 election don dey near, and many Nigerians dey ask, "Why be say na now wey election wan come President come dey find fresh loan again?
Shey the plenty loans wey we don borrow before never do?
"The matter don cause gbas-gbos for social media.

No comments:
Post a Comment